Friday, August 28, 2015

WHAT BOKO-HARAM GO MAKE US DO

Dem say Boko Haram don poison beans after I buy half bag for house. From the one wey I cook, I give my dog, Bingo, make im first test am. 45mins later, bingo still dey waka, dey jolly. Na im I
come chop my own. After I don chop finish, my gateman run come tel me say bingo don die, hey! I run enter house, begin drink full gallon of palm oil for my belle, chop 22 bitter kola wit 3 long bitter
leaf stem, chop walnuts with the shell no time to crack, swallow moringa with aloe vera as treatment
combo. Garlic and onions be like sweet for my mouth. I come dey sweat as if na oven be my bedroom. I dey think say my life don finish. I come outside. Na im gate man com they
tell me say the driver wey kill bingo wan come beg me! 

If na u, wetin u go do the gate man???

No comments: